Key Bb

Intro:
Pit is met for those who dig pit
And trouble is given to those who want trouble
The joy of the lord gives me big big strength to jump over pit abeg o
Abeg o
Who dig this pit go fall inside
Verse 1:
Look it is not a sin for me to serve God now
You go just dey give me wahala
Shooo
Any pit wey dem dig for me
Jump am pass
Whether na my mama na hin dig am o
Weda na my papa na hin dig am o
I no care know who dig the pit o
I say Weda na my landlordu dig am o
I say Weda na your co telanti dig am o
I say Weda na your friendi na hin dig am o
I say Weda na your brother na hin dig am o
Abi na your mother in law na hin dig am o
Abi na your father in law na hin dig the pit o
No be you get am at all at all o
Make you jump am /5x
Chorus:
Na which day you go jump the pit sef
Today today I go jump over the pit patapata 2x
Na which year you go jump am o
Today today i go jump over the pit patapata
Verse 2:
Chai it is not a crime for me to serve God now
Una don see where back tire they overtake front tire for moto
Abi fly go fit hold choir practice inside hot oil
Chai
Call:
I say any pit wey dem dig for me…2x
Abi na my enemy dig am o
Abi na secret cult na dem dig am o
Weda na witches dem dig am o
Weda na ogbanje people dig am o
I say Weda na babalawo dig am o
No be you get am at all at all o….2x
Dem dig am for you to Dey siki siki
Dem dig am for you not to progress
Dem dig am for you to die untimely death
Dem dig am for you to Dey beg food
I say no be you get am at all at all o
Weda na your toilet dem dig am o
I say Weda na your parlour dem dig am o
Weda na your area dem dig am o
Weda na your car dem dig am o
Make you follow me o jump am jump am……4x
Chorus:
Na which day you go jump the pit sef
Today today I go jump over the pit patapata 2x
Na which year you go jump am o
Today today i go jump over the pit patapata
Verse 3:
Look if na you sit down on my success
It is either you pack or you die……2x
Ahhh come make I tell Una
If devil Dey pass your backyard
Say hin Dey go hin family
Tell you say make you keep this cutlass for am
Na lie no keep am o, bcos he won take am kill you
Bridge:
The word of the lord don yarn me this one
Word of the lord don tell me this one
The weapons of my warfare are not carnal….2x
But they are mighty thru the pulling down of strong holds…..2x
If you are fighting the devil no carry cutlass
No carry your gun
Dey will fail you…..2x
Put on the whole armour of Jesus Christ ee……2x
Hear me say
put on the belt of truth on your waist
Put on the breast plate of righteousness
Put on the helmet of salvation
Odechi shield of faith in your hands
Hold the sword of the spirit in your hands
Put on the bigi gospel apola shoe
Then you know you are ready for the battle
You go Dey pose, you go Dey jump am pass….3x
Call:
Any pit wey dem dig for you
Weda na your director dig am o
Weda na your co worker dig am o
I say Weda na your cotrader dig am o
Weda na your business partina dig am o
I say Weda na your lecturer dig am o
Dem dig am for you not to progress
Dem dig am for you to Dey siki siki
Dem dig am make your business Dey faili o
Dem dig am make your things Dey spoil o
Dem dig am make you no progress for life
No be you get am at all at all o
Make you follow me o jump am /4x
In Jesus name you must to succeed o
I say Weda na your toilet dem dig am o
Or ma your backyard dem dig am o
Any pit wey Dey dig for me
Resp: jump am pass
Chorus:
Na which day you go jump the pit sef
Today today I go jump over the pit patapata 2x
Na which year you go jump am o
Today today i go jump over the pit patapata
END
